See how opposition dey celebrate Supreme Court judgment

Published

When di Supreme court cancel di August 8 presidential election wey Uhuru Kenyata win, everywhere spark for Kenya

NASA Presidential candidate Raila Odinga dey talk to tori people for front of Kenya Supreme court
Wetin we call dis foto, Opposition leader, Raila Odinga dey talk to people after Kenya Supreme Court announce di court decision
People dey jubilate for road for major road for September 1 when di Supreme court cancel di August 8 presidential election
Wetin we call dis foto, People enter road and start to dey jubilate
Over happy hold dis two people People so tey dem begin roll on top major when dem hear di September 1 Supreme court wey cancel di August 8 presidential election.
Wetin we call dis foto, Dem over-happy for the Supreme Court decision wey cancel di August election
Young people for Kisumu region wey dey happy when dem hear di September 1 Supreme court wey cancel di August 8 presidential election.
Wetin we call dis foto, Young people join di jollification for Kisumu, wey bi place where opposition leader, Raila Odinga, get plenty fans
People wey remove shirt and odas wey drive motorcycle for streets of Kisumu as dem hear di September 1 Supreme court wey cancel di August 8 presidential election.
Wetin we call dis foto, Kisumu na one of di region wey di people vex pass when electoral commission say na President Uhuru Kenyatta win
Supreme court judgement for Kenya presidential spark some people head so tey dem carry flag join on top di jollification
Wetin we call dis foto, Before di supreme court announce di result, area been quiet because people dey fear say fighting fit start.
Young girls and boys dey dance on top di supreme court judgement wey cancel di August 8 presidential
Wetin we call dis foto, Di next thing now na to do another presidential election and di supreme court don say na sixty days dem get to do am.