Eleven don die for South Africa storm

Container ship dey block di mouth of harbour for Durban, South Africa, 10 October 2017
Wetin we call dis foto, Container ship bin block di mouth of harbour after e move from di place wey dem park am because of flood
Published

Over eleven people na im die after one heavy storm scatter KwaZulu-Natal region for South Africa.

Di storm blow away ships wey dem park come block di harbour so other ships no fit pass.

Di people wey die for di storm na one pickin wey water carry go and two people wey wall fall on top dem for hospital near Durban, di main city for di region.

Supercell thunderstorms na wetin dem dey call storms wey dey form to look like tornado.

People wey dey stand for central reservation bin dey look motor wey dey soaked inside water on a flooded road during stormy weather in Durban, South Africa, 10 October 2017
Wetin we call dis foto, Motorists dey road for several hours inside di storm wey happen for city wey dey near sea for South Africa

October na month wey rain dey fall pass for Durban.

People enter flood water and strong winds with near motor wey soak for di water for storm for Durban, South Africa , 10 October 2017

Port authorities talk sadi storm carry three ships comot from water come land on top land.

Tree wey fall for road cause traffic for Durban, South Africa October 10, 2017
Wetin we call dis foto, Di storm scatter everywhere and cause serious traffic problem for drivers

Di Durban port na im busy pass for Africa but authorities don close am because of di storm.

Cleaners dey mop water for King Edward VIII Hospital for middle of storm in Durban, South Africa, 10 October 2017
Wetin we call dis foto, Water full everywhere, including King Edward VIII Hospital for Durban