E pass 200 prisoners wey escape from Nigeria prison - Minister

Published
Abdulrahman Danbazau wey be Nigeria Minister of Interior don confam say 210 inmates escape from di Minna Maximum Prisons for Niger State, northcentral of di kontri.
Di inmates escape afta some pipo wey cari gun attack di prison on Sunday night.
Di Minister wey follow Niger State Govnor Abubakar Bello waka go see wetin happen for di prison, say dem don arrest over 35 of di inmates wey bin run.


















