Aisha Buhari Cup 2021: Nigeria First Lady Aisha Buhari Invitational Women’s Football Tournament for Lagos - Facts

Wia dis foto come from, Aisha Buhari
Aisha Buhari Cup 2021 go kick-off for Lagos, Nigeria commercial capital.
Di Aisha Buhari Invitational tournament na association football tournament wey Nigerian football federation organize.
Di theme of di first edition of di competition wey NFF put together for di female national team na "playing for good".

Wia dis foto come from, Other
Basic fact about Aisha Buhari Cup 2021:
Aisha Buhari Cup 2021 wey go start on Wednesday 15 September na a programme of Nigerian Football Federation.
Dem name an afta Nigeria First Lady, Aisha Buhari wey don endorse di competition.
Di organizers for dia website say "na one of di programmes aimed at uplifting di girl/child for di continent.

Wia dis foto come from, Faith Oluchi
Aisha Buhari Cup 2021: How di tournament go hold
Na six kontris go participate for di tournament wey go last only one week.
Di participating kontris na Ghana, South Africa, Cameroun, Mali, Morocco and Nigeria.
End of Di one wey oda users dey read well well






















