Catalonia: People dey protest arrest of Catalan leaders

Protests in Barcelona
Wetin we call dis foto, Protesters carry signs wey say "Freedon for political prisoners dem"
Published

Thousands of people for Catalonia region for Spain don come out to do I-no-gree on top di arrest wey Spain don arrest eight regional ministers wey dem just sack because of di independence wey dem declare.

High Court for Spain charge dem say dem dey cause trouble, dey do rebellion and dem use government money anyhow.

Government lawyers still wan arrange European arrest for Carles Puigdemont, di Catalan leader wey dem sack wey come run go Belgium.

Dem still dey find four other ministers wey no show when court order say make dem come answer case.

Independence supporters protest against the judge order on Catalan leaders to be held in custody in jail pending trial on November 2, 2017 in Barcelona

For Thursday, people reach like thousands wey show for outside di building of Catalonia regional parliament for Barcelona.

Dem carry Catalan flags and dem dey sing "Freedom for political prisoners dem".

People for other areas for Catalonia follow do dia own.

Political parties and groups wey dey fight for people's right dem come out come talk say wetin di Spanish authorities do no good.

Protesters outside Catalonia's parliament in Barcelona. Photo: 2 November 2017

Serious political palava na im Spain dey face ever since people for Catalonia region do referendum for 1 October say dem want independence from Spain, even after one constitutional court say e dey illegal.

Na last week Spanish Prime Minister Mariano Rajoy nack direct rule give Catalonia after im remove dia parliament and announce say dem go do new elections for 21 December.

Di Catalan government bin vote to declare independence from Spain.

Dismissed Catalan cabinet members (L-R): Interior Minister Joaquim Forn, Foreign Affairs Minister Raul Romeva, Labour Minister Dolors Bassa, Government Presidency Councillor Jordi Turull, Justice Minister Carles Mundo, Sustainable Development Minister Josep Rull and Culture Minister Meritxell Borras arrive at Spain's High Court
Wetin we call dis foto, Dis na seven of di eight former Catalan ministers wey show for court

Dis na di Catalan ministers wey dem arrest:

  • Former Deputy Vice-President Oriol Junqueras
  • Former Interior Minister Joaquim Forn
  • Former Foreign Affairs Minister Raül Romeva
  • Former Justice Minister Carles Mundó
  • Former Labour Minister Dolors Bassa
  • Former Government Presidency Councillor Jordi Turull
  • Former Sustainable Development Minister Josep Rull
  • Former Culture Minister Meritxell Borras

Dem give former Business Minister Santi Vila, bail because im resign before di Catalan parliament vote independence.

Mr Puigdemont don comot to talk say wetin Spain do no follow how e suppose be for democracy.

"I demand say make dem release di ministers and di vice-president," he added.