South Africa police dey investigate murder of foreign citizen wey be victim of assault

Wia dis foto come from, RAJESH JANTILAL / AFP via Getty Images)
Police for KwaZulu-Natal Province dey investigate di circumstances around di murder of one foreign citizen, wey dem believe say dey in im his late 30s or early 40s.
Police say one group of pipo allegedly assault am to death on Thursday morning, 22 October 2026.
Authorities say early reports wey dey available suggest say di group of pipo bin dey march on Dr Pixley kaSeme Street towards Maud Mfusi Street for Durban city centre.
During di march, tori be say two men comot from di group and waka go meet one man wey dey for di roadside.
Provincial tok-tok pesin Colonel Robert Netshiunda say: "Dem further allege say di group of about 50 pipo assault di man wey dem declare dead for di scene.
"Police dey follow several leads and use all investigative aids to identify possible suspects. Di motive of di killing dey unknown at dis stage and dem dey beg community members make dem no dey spread unverified information"
Di protests na di latest for di series of demonstrations for di city in recent weeks wey be about service delivery complaints and anti-immigration riots.
However, police say e neva dey clear at dis stage if di attack dey linked to anti-migrant sentiment.
Dem neva know di kontri wey di victim come from.
Netshiunda tell di BBC say dem no go fit guess on di motive of di killing and say dem go share more information once dem verify am.
How foreigners dey fare for South Africa
For October, one Nigerian Ijeoma Pauline Eze wey originally come from Imo State, southeast Nigeria bin tell BBC News Pidgin wen she bin return from South Africa say evriwia for dat kontri dey hot now for foreigners, especially Nigerians.
"Wetin make me come back na di way wey police, individuals dey harass us, in fact evritin don worse now. Most of our brodas I dey cry for dem becos dem dey always intimidate dem. Weda you do anytin or you no do anytin, dem go look for any allegation put for your head just to make sure say dem hurt you. So di way e be now, e too hot, you no go fit go for business now and come back in peace. If we dey go we dey fear, if we dey come back we dey fear," she tok.
For September, Nigeria consulate for Johannesburg bin allege say three more Nigerians die for South Africa within four days sake of di xenophobic tension wey dey continue to rise against foreigners for di kontri.
Di Nigeria Consul-General to South-Africa, Ninikanwa Okey-Uche, condemn di killings of Nigerians wey happun less dan one week dat time, between 18 and 21 September.
Earlier for September, Nigeria govment bin warn against xenophobic attacks against dia citizens for South Africa, afta dem kill two Nigerians - Bishop Taiwo Michael Fakunle and Mr James Uchechukwu for South Africa.
Nigeria govment tell di South African govment say dem no dey happy at all ova di attacks but di South Africa Independent Police Investigative Directorate (IPID) tok say dem go investigate di matta but dem neva still report dia findings to di public.
Nigeria govment and oda kontris wey dia citizens don be victims of dis attacks still dey call for calm and tok-tok as dem dey advise dia citizens to dey safe.
Nigeria govment tell dia citizens for South Africa say make dem "remain calm, law-abiding and security conscious in di midst of di ongoing xenophobic/Afrophobic attacks, threats of attacks, general insecurity and ill-treatment wey dey happun among black African foreigners for South Africa, especially Nigerians".



















